Oga president,
First of all I hail ooo! I no say u no dey cary last. You be confirm warri pikin. But ur middle name Ebele means mercy and make u pity ur children settle their lecturers naa! The matter neva tire u? Suppose say ur pikin wey u born for belle follow us dey house, Sheeh you for never answer our we lecturers them? Una say make we bone kidnapping, militant things and all the bad bad things go enter school, now now na una com dey f**k up. All the things wey them lecturers don teash us for klass we don forget am finish. Last last, na una go still call us "half-baked", "half-roasted", abi na "half-fried". Na una sabi.
Them talk say person no fit run pass him shadow. We go dey lasgidi dey for you. Na ur time be dis use am well, but we go catch you for 2015. U don forget say youths na we dey vote pass. Na we too dey snatch ballot box, dey do rally and som kain kukere things them wey them dey take win election. U go still nid our help. That time too we go go strike. Shebi u sabi waka for bare feet, u go carry ur leg do ur rally. No thugs for u. We no go snatch ballot make you for win. If any maga try am we go fall am.
So Oga Jona, na ur opportunity be dis ooo. Make u code this stubborn ASUU make dem cary their wahala go back. We no say na rush them go rush us we no send. All join. Na who get leg dey pass exam no be who read. Na still who get leg dey get beta work. Na Naija we dey. So make u do something because our mate dem for private university don graj finish. We don tire to dey beef them. If u no shake bodi fast make u no forget say university of militancy still dey admit. Dey neva release 2nd batch ooo!
May u grit maale Patience for we, thank baba God say she and gran papa Soyinka don settle that their quarrel, 2 agbayas, plus all those bad belle advisers wey u get. God pass them! Bros Amaechi still dey Niger-delta here, the guy don tire for ur mata. We dey grit u for am too. We go stop for here. E go be na. Naija! student for life!
Na ur waffi boy.
#CEO

u try well well my waffi broda
ReplyDeleteAbeggi make I hear word! Nothing waffi for inside.
ReplyDeleteGuy i like as you don yan bros jona so, abeg help me tell am say house don tire person oooo, our mate don dey perish small, make e no kill d future leaders finish bcos of this asuu strike. Tell am make em remember say 2015 still dey on point ooooo. I won rest ma stori for here.
ReplyDeleteNa truth my broder
ReplyDeleteBig bros,
ReplyDeletei de hel you!
You done try wel wel,
in 2015 jona wil not get one vote!!
Yes ooooo,Bros Jona realise us oooo,hmmmm
ReplyDeleteI no fit laugh oooo
ReplyDeleteSo dry...waffi yarn tyt pass dis..d publisher dey learn work
ReplyDeleteLaugh wan kill me die...hahahahehehe
ReplyDeleteBros jonahhhhhh shebi I don hear qwuohhh? If I no go reason wit asuuuuuuuu, God go purnish me b'cos if I catch me. Dat's an hausa man speaking british angleyh. Nw Jona d fifa de ur 18 yard box ooo!!!
ReplyDeleteBuahahaha @na who get leg pass dey pass exam n na who get leg pass dey gey beta job... I wipe for naija...
ReplyDelete